Happy Valentine #SabiNation. For today episode, we talk one funny valentine story from our past.
We go like hear una own valentine story too.
Una fit also call our number +1 (240) 459-8364 and leave comment for voicemail, or use dis link https://wa.me/qr/ZYXR5W3OAUFWL1 add us to WhatsApp and send voice-note. We wan hear from una.
Follow us on social media too;
Facebook: How Una See Am Podcast
Instagram: @officialhusapodcast
Twitter: @HusaPodcast
YouTube: How Una See Am Podcast
My own ennnh, as I old reach I never get any valentine special moment, but I dey always receive gifts sha. As I dey reason am lately, I just conclude say this Valentine celebration no be for everybody ooo.
No be Lie @DrTwinMom… just as life no balance, na so dis Valentine matter be. While some pipo go dey get car as valentine gift, some pipo, na packet of St Lois sugar dem dey get as gift.
My own memory:
Dat time wey I dey school, I be get boyfriend oooooooo but we no dey do d Val together
Na me and my girlfriend, we go dey waka from one hostel to another to see wetin other girls get for Val.
Las Las, people conclude say we be lesbian 🤣🤣🤣🤣🤣
No mind dos pipo o… na so dem go dey suspect wetin dem no know… hope sey di tori don change now sha?