#SabiNation, one of di segments for How Una see am Podcast na #OurFavoriteThings; wer we for dey talk about things wey we like. Today, Maazi sey make I talk about one of my favorite things so I decide to talk about my favorite Sportswear.

My favorite sportswear brand na Adidas. I don like am since I small. E fit be sey na because most of my canvas wen I small na Adidas but even as I don grow, something about those three tripes dey always catch my attention. Because I like di brand well well, I con go dig into the history of the brand and wetin I find make me con make me even love di brand more.

Dis na some things wey I find from the history of Adidas;

  • Dia name wey dem take start business between 1924 to 1949 na Dassler Brothers Shoe factory.
  • Na dem help di Sporting Federation create running shoes wey get spike under the sole wey sport pipo dey use for track and field events.
  • Dat time, na leather dem take dey make the top of shoe and bcos dem put spikes, na metal dem use for di sole and dis one co make di shoe dey heavy one kin… So Adolf Dassler con decide to use cloth wey dem make from cotton and hemp take make the top of the shoe and then use rubber make the sole. this material naim dem call ‘Canvas’.
  • For 1936, Adolf Dassler convince American Sprinter, Jesse Owens make he wear di handmade spike wey him make for the summer Olympic of dat year. Na der dia market for blow!
  • Small time Adolf Dassler and him senior brother Rudolf Dassler con begin get gbege ontop the company matter and con decide to separate and go dia way. Adolf, Adi as him mama dey call am con short him first and last name, Adi Dassler to ‘ADIDAS‘ while him senior brother call him own company ‘PUMA
  • Over the years, the company don go from making shoes for track and field to making complete sportswear for all sports. Also several other companies don buy am from the original owners.

Dis history and many childhood memories join wetin make me love the brand, Adidas.

#SabiNation, Wetin be una own favorite Sportswear?