As we dey return from our short break, and as father’s day dey near small small, we sey make we hail our men and remind dem to take care of dia health… as dem dey tell us wen we small, “HEALTH IS WEALTH”.

We look book, see sey the top 10 health risk for men na;

  1. Heart Disease
  2. Respiratory Disease
  3. Alchohol: diseases wey too much drinking dey cos.
  4. Mental Health: Anger, Depression and Suicide
  5. Accidents and Injuries wey dey happen unintentionally
  6. Liver Disease
  7. Diabetes
  8. Influenza, Pneumonia and Covid
  9. Skin Cancer
  10. HIV, AIDS

We also find some health tips for our men;

  • Visit your Doctor regularly, and dat one include ur dentist too.
  • Try dey eat Natural food, less fry fry and eat ur vegetables and fruits.
  • Dey try exercise. We too sitdown. Move! Jog, run or just simply waka. If yu fit go gym, DO AM!!!
  • Maintan healthy waist. If ur waist don dey pass 40 inches, e don dey open room for some kin obesity related diseases be dat. WATCH AM!!!
  • Vitamins. All the Vitamins from A to Z wey dey important, try get dem daily.
  • Break unhealthy habots like smoking, too much drinking, lack of sleep e.t.c
  • Protect your skin.
  • Go do Prostate test. Early detection fit save ur life.
  • Go do Colorectal test; dis na to test for colon cancer wey don kill many men.
  • For ur mental health, try talk to professionals lik therapists or councelors wey fit help yu with mental issues.

For men, to face our health issues sometimes dey dey scary but wen we avoid am, e dey fit lead to serious problems and death sometimes. Dem get plenty resources wey we fit read about men health and plenty organisations wey fit help with any kind of sickness or diseases wey person fit get. If yu dey experience anything health-wise wey dey giv yu concern, try go for test or check up and beside that make we make our health priority and live healthy lifestyle, remember sey PREVENTION BETTER PASS CURE.