#SabiNation, for today episode, we talk about di Tokyo Olympic wey just conclude con look di matter enter how we take like sports for school and street dat year.
To leave us message, you fit go on top our social media platforms;
Facebook: How Una See Am Podcast
Instagram: @officialhusapodcast
Twitter: @HusaPodcast
YouTube: How Una See Am Podcast
Una fit also call our number +1 (240) 459-8364 and leave comment for voicemail, or use dis link https://wa.me/qr/ZYXR5W3OAUFWL1 add us to WhatsApp and send voice-note. We wan hear from una.
**Music Credits:
UNITY by HUSAPodcast, YellowFela Production
Mazi and Femo e be like nah street una from comot o😃
I dey always enjoy una talk. I love olympics o. My pikin dem sef know say something dey happen as I commandeer the television.
This year olympics sweet. I like the new sports. I also like the sports wey them join man and woman to do a game togeda. That naija relay nah wah. I tink say we go get first 3 sef. It is well
Una well done o
You be korrect Olympics fan. Me sef gbadun the sports wey men and women compete, e get one wey woman carry gold and men carry silver and gold…dat one sweet me wehweh.
Ben Johnson no be hairstyle too, that time?
I no remember Ben Johnson as hairstyle dat year, but I remember sey if yu dey run from something, dem go sey yu “Ben Johnson”
The decline of Nigeria’s sport industry started when the country abolished secondary school inter-house sports thereby making it difficult to scout for and develop young talents.
Na so. Dem dat dream from di bud. Sad