#SabiNation, all news media across di world right now dey talk about dis America and Afghanistan matter, and as usual different different version of di story naim dey fly upandan ontop social media. So today we sey make we bring one of our bros wey sabi di matter well well to com disect am for us.
Our guest host today an Adeolu Balogun, Host of “Atlanta discuss with Ade Balogun“
To leave us message, you fit go on top our social media platforms;
Facebook: How Una See Am Podcast
Instagram: @officialhusapodcast
Twitter: @HusaPodcast
YouTube: How Una See Am Podcast
Una fit also call our number +1 (240) 459-8364 and leave comment for voicemail, or use dis link https://wa.me/qr/ZYXR5W3OAUFWL1 add us to WhatsApp and send voice-note. We wan hear from una.
**Music Credits:
UNITY by HUSAPodcast, YellowFela Production
I Dey hail you o! Great podcast, and your guest Ade Balogun dropped great gems of Wisdom 💎loved the gist, and I learned more about the Afghan Wahala and loved how you all compared it to the insurgence, insecurity and terrorism in Nigeria and across Africa. Make we shine our eye and prepare in Naija 🇳🇬before we go end up in worse situations like Afghanistan 🇦🇫o!
Una do well oooo…I be blank concerning this matter but my eyes don open o! Make una continue the good work!!!
Dis bros na real Tory man. He sabi break down the story. Nice episode.
Shoot one kill 50
Any place wey people gada, the pipo wey nor good must stii dey inside. I don see as pipo wey dey look the Afganistan matta don dey fear make this kain tin nor happen for naija eapecially as the bandits from north and militants from south don dey reggea. My own na say make everybody for naija join hand to talk say anybody, no matta who e be, wey kii naija person musto see pepper. Na to take one naija eye look the matta, na there answer go dey. Bad people full everywhere, Taliban nor good, me sef nor good finish, but all man musto respect hin fellow man, make betta hamma nor nack our head, make people nor tell us ooyin unto gbege wey we go enter if we kii one single person.
Nice one Mazi and Femo. English is loghor, but pidgin is simpo😀
Hahahahah… Inglish is very loghor sir
Excellent guest. Military Industrial Complex is the reason for endless war. Too many contractors making money. Khasai was too duplicitous for my liking and added to the furthering of the war. Ghani was a straight crook. I believe the US wanted this to happen but domestic politics always poisons the narrative. China and Russia have their own islamic problems too. Lastly, Nigeria has a fulani problem aided by the Arabs that the yoruba and hausa need to wake up to. The Igbos I think are ready but as your guest said it would take cooperation of the Yorubas to work. I don’t see it. Great discuss. Una too try for the questions too plus the best guest. Una doh o.
Pete, our pipo talk sey…”na cooperation dey make beans don for pot”. If Yoruba and Igbo no work togeda, both of dem no go fit actualize that Odua/Biafra dream…but just like you.. I no see that cooperation AT ALL!!!!
How Una See am?
This Taliban mata for Afghanistan weak me well well. But e una no go blame US Govt true true dem don spend too much money to train and equip Afghan soldiers wey suppose keep peace. But as dem no fit do am, the Taliban com take control e show say Terrorism still dey well well and another case study be Nigeria i hope say our government no go do like Afghan government. 🙏
Una weldone
Yes o, Nigerian politicians and leaders need to pay serious attention to dis matter.