#SabiNation, as today na di last friday of di month, we say make dis episode dey more fun and relaxing so we decide to go back in time to count some songs wey hit weh weh dat year but con later fade lik mess 🤭 😂
Our bro, Pete Agidigbi waka pass studio to greet us today.
To leave us message, you fit go on top our social media platforms;
Facebook: How Una See Am Podcast
Instagram: @officialhusapodcast
Twitter: @HusaPodcast
YouTube: How Una See Am Podcast
Una fit also call our number +1 (240) 459-8364 and leave comment for voicemail, or use dis link https://wa.me/qr/ZYXR5W3OAUFWL1 add us to WhatsApp and send voice-note. We wan hear from una.
**Music Credits:
UNITY by HUSAPodcast, YellowFela Production
Maazi and Femi, i thruway salute… But i no totally agree with una. I settle down compile una list and I agree say nah great songs and I hail dis great musicians for wetin dem put into their music
10.Gini – Ego
9. Onyinye – Obi 1
8. Kuchikuchi – Jodi
7. Greenland – Ty Bello
6. Shayo – Bigiano
5. Soul E Baba dey here – Soul E
4. Baby Konga – Konga
3. New Dance – Marvelous Benji
2. Kerewa – Zule Zu
1. Dem go dey pose – Baba Fryo
These songs carry heavy lyrical content, unfortunately at the time we these guys dey wax their music, doing music no really easy as regards finance, studio time and hitting target audience. So abeg make we no refer to these guys as 1 hit wonders, nah condition make cray fish bend. Besides person wey dey do music that time if Kennis no sign u, nah OYO u dey. Thses guys virtually has to go to Alaba to sell their mix tapes. Most of the new generation artist, technology and the hustle wey these old ones do epp dem well well. So Kudos to the supposed one hit wonders.
We thank yu for ur comment bros… but as we call dem ‘1 hit wonders’ no mean sey we no like dem o or sey dem no try… na hail we dey hail di effort wey dem put into dia music wey make am be talk of di town at dat time. Music no easy, content no easy, but dem put dia work out der and e turn to household chorus, no b small thing at all. So again, na hail we dey hail and wish sey we fit hear from dem again. Oya bros, give us ur own list of hits of data time wey yu wish sey di musician fit giv yu anoda hit lik dat 🙂
Memories are golden…. I practically know all the songs. Thank you mazi Omari and uncle Femi for this episode.
Brilliant !
A fantastic way to start your Friday evening.
I love the dedication 👏
Chai! Femi and Mazi una carry go back old times. But some of us no know some of the oldies o e be like una two old well well.
Me like number 7 by TY Bello the land is green and that baby konga I dey wonder wetin happen. I no know say them ban am. And of course number 1 – denge pise nah better song o. E sweet me that time.
Una try. Nive memories wey I get today sha.
Happy Friday guys..
Naija music all the way 🙌👌👏..
I remember and love most of the songs..Nice memoriessss.. with particular reference to
dem go dey pose.. dem go dey dengedenge.. dem go dey wakakurukere…
ewo if u help me see ego and ayangba girls…
Welldone guys… una too much sabi nation..
Yes o!!!!… naija musik all di way. e bi lik sey yu groove weh weh dat year o… Lol
Thank you Femi & Mazi for taking us down memory lane.. I enjoyed every bit of it…make una keep up the good work o!