#SabiNation, today, we decide to look dis vaccinate or no vaccinate matter and we try filter di lies from di truth so dat pipo wey wan vaccinate fit go vaccinate wit konfidens and di ones wey no wan vaccinate make dem kip kwayet and stop to spread dangerous lies. #HowUnaSeeAmPodcast #FemiAndMaazi
To leave us message, you fit go on top our social media platforms;
Facebook: How Una See Am Podcast
Instagram: @officialhusapodcast
Twitter: @HusaPodcast
YouTube: How Una See Am Podcast
Una fit also call our number +1 (240) 459-8364 and leave comment for voicemail, or use dis link https://wa.me/qr/ZYXR5W3OAUFWL1 add us to WhatsApp and send voice-note. We wan hear from una.
**Music Credits:
UNITY by HUSAPodcast, YellowFela Production
Photo by Artem Podrez from Pexels
I salute una
I jus want tank una for dis episode as naija pipu still dey fear d vaccine.
My brothers, Una do well as e be say Una talk am as e be. The myths wey una debunk so and the correct info wey Una share go hopefully help many of our people…as Shaggi talk, a word is enough for what? A word is enough for (a while) … the wise 🤣
🤣🤣🤣🤣🤣…. for ‘a while’ o
I hail o. Una do well as una educate us. Una know say when e come to Nigeria matter, our things dey dey different. Make God help us. Femi & Mazi, I salute o
I feel say first and foremost vaccination no dey bad na to just make we protect ourselves from Corona virus no be today we don dey collect vaccine e don tey wey vaccine don dey.
Secondly i no think say e normal to force anybody to take am cos no be by force to take something wey you no wan take.
Like for Naija i dey hear say government wan make am compulsory e no suppose be like that make the thing be freewill.
Na my own take be that. 🙏
But Oga Sunny, when we dey primary school, I remember sey e get one time wey dem dey pursue children wey never get (I think yellow fever or Lassa Fever) vaccine go house dat time o… I remember sey an YWCA for airport road Benin my papa carry us go collect the vaccine dat time and di queue long dat day… Fast Forward to NYSC, we no fit register for North den if we no show sey we don get meningitis shot… infact pipo wey no show dia vaccine card collect the shot for camp there…today, yu no fit enter some countries if yu no show ur ‘yellow card’ wey be proof sey yu don take certain vaccinations, not even Covid sef….. the point be sey, no be today government dey mandate vaccination… dis one only different becos of all di lies wey follow d matter thru social media
Choi!!!!! Una don educate people wey go listen to this o. Una do well! Kudos!!!!!
Thank you!
Una welldone!
The enlightenment wey una don teach no be here.
The truth be say una no go blame people for helping to spread these false tori, the propaganda wey dey ontop social media plenty especially between world powers like US and China,
and una know say social media dey addictive and engaging.
then the 5G matter and the race between world powers on who go control the super highway wey the data go dey flow between US and China dem follow heat up the propaganda.
Imagine say dem talk the 5G own and then next day you begin see technicians begin Bury transmission cables underground for your backyard to accommodate the high bandwidth wey e go carry, if you no dey enlightened you go fear the tori.
Shey any government come out and do awareness campaign for the media about these false propaganda being spread on social media?
For nigeria for example till now no media campaign about vaccine, about 5G and its advantages, about diseases and their history by government and even NGOs.
See the small campaign wey una (Dr Mazi and Prof Femi) don do ontop this episode e plenty pass anyone wey any government don do.
For Nigeria sef, the vaccine no dey available, when you go queue to take am before e reach your turn dem go say e don finish.
In summary vaccines good especially for covid 19 bcos the disease dey real ooo so make anybodi no gawk am o! but make the government’s especially nigeria use same social media wey dem take spread false tori to also spread good tori about the vaccine to appeal and encourage people and importantly make them provide am yanfu yanfu bcos plenty plenty people wan take am but e no dey reach all.
Una do ooooooo.
Yu make sense, @Richie!!!
I don talk am b4 and I go talk am again, who go die go die. Na force dem TK dey vaccinate person??? I no go vaccinate until five years to come because food when dem rush prepare dey get coma at the end of the day. People when go vaccinate no dey fear their life. U carry wetin dem rush do put inside ur system. Well I will say rest in peace in advance. Na one life I get, I no go use am gamble with the oyinbo man when prepare that vaccine. The people when prepare d vaccine no even know d effect after 5 to seven years. People when TK the vaccine na experiment dem use una for. I dey wait to see how the vaccine go react b4 I go try TK am. My younger sister don TK am🙆🙆🙆,but me go wait to see.
Uncle Kongaga… as we put mouth for dis matter, we make am clear sey e dey okay if yu no wan take di vaccine but we dey try minimize di spread of false information and fear. I see ur point sey e wan b like sey di thin quick comout and many pipo get d same concern… but di truth be sey, technology don advance pass as e dey dat year… just see how technology for communication don make Samsung and Apple fit dey release many new models of phones in a year, compared to dem Nokia, Motorola, and Sagem dos days… na so technology don make am easy for science to develop things and share data with laboratories all around the world… dat time, 5 to 10 scientists for one lab fit dey work on something for many years, but now, with improvement in technology and data collaboration, scientists all around the world fit put heads 2geda to make things happen quicker.
Also, bros, ur younger sister wise!! 🤭😊😂