#SabiNation, today, we torchlight di many many danger wey hide inside sugar, dis sweet substance wey don take style creep enta all our diets. We discuss how e take dey affect our health, how di sugar industry dey promote consumption, and we share some tips on how we fit reduce our sugar intake make we for fit dey live longer and healthier life.
To leave us message, you fit go on top our social media platforms;
Facebook: How Una See Am Podcast
Instagram: @officialhusapodcast
Twitter: @HusaPodcast
YouTube: How Una See Am Podcast
Una fit also call our number +1 (240) 459-8364 and leave comment for voicemail, or use dis link https://wa.me/qr/ZYXR5W3OAUFWL1 add us to WhatsApp and send voice-note. We wan hear from una.
**Music Credits:
- UNITY by HUSAPodcast, YellowFela Production
No be small mata be ds sucre tinz o infact if we look at d rate and medium wey we tak de consume Sugar via wetin we de chop unknown 2us we no go belif am……… Foods n drinks wey we de consume hmmmmmm mak we de chek am ni oooo.
Nice episode brother.
Kudos!!!
Una really try 4 dis today’s topic walahi
As everyone dey chop sugar directly or indirectly…….but mak I no lie, to comot bodi 4 all dis sugar-base chops no easy as per eating organic n natural food dey expensive too
Mak God help us sha
And sharing your personal experience on the podcast was a plus on this platform, may our health not fail us
Thank you for today’s topic
🙌🙌🙌 sabi nation
Una do well for this matter.
I sat down with one doctor friend a while ago and he said to me, the less you eat, the longer you will live.
Some of us dey kill ourself with food and we call it enjoyment.
“You eat to live” NOT “ live to eat” 😀 if una understand that proverb wey I give, una life go last well well.
I go dentist for the first in my life March 2023 as a 50yrs old man. The dental office tire for me. They were in shock and how e happen and my teeth still Bam!
I sey na africa I grow and candy and chocolate na luxury 😀😁.
Even minerals or soft drinks na party or ceremony. Thank God for africa poverty 😀😃. At last to live in small lack come give me gain.
My kids now dey use drink dey step down their food. When I stop the flow, my kids think sey i dey too hard on them.
I told them that I am trying to preserve their life.
Here is my Last word!!
Fear sugar pass as you fear Devil.
Make churches begin rebuke sugar instead of devil 😀😁
As for Bread, I have finally signed the divorce certificate. 😅😁