Plenty communities for Lokoja including major highways don experience wetin the people for that Lokoja community dey call the worst flood wey dem don ever experience. Dis flood palava don render plenty pipo for that community homeless and e don make life come hard well well for them. Report wey reach us for Sabi Nation say pipo don even die because of this flood matter.

The Kogi State governor Yahaya Bello don ask President Mohammadu Buhari say make e declare Kogi state national disaster zone because of this flood palava. According to the state governor, him say this declaration go make the government to put more effort to help the people wey this flood affect.