Police don use tear gas chase di Nigeria youths wey dey do march to mark di 2nd year anniversary of #EndSars protest.

Di protesters bin gather as early as 9am Thursday morning 20.10.2020.

More dan 40 #EndSARS protesters still dey prison without trial – Amnesty Int’l

Dis na two years since di #EndSARS protest, and one human rights group say more dan 40 of di protesters still dey for prison for Nigeria

Amnesty International don write for dem report in remembrance of di 20 October 2020 #EndSARS protest, say more dan 40 of di protesters wey di Nigerian goment bin arrest dat day still dey prison without any trial.

Di international human rights group say all di panels wey di Nigerian goment set up to investigate police impunity don fail to deliver justice to hundreds of victims of police brutality.

“Di fact say dem neva bring anybody to justice over di killings, and torture for di #EndSARS protesters na stain on di Nigerian human rights records. Meanwhile, Osai Ojigho, Director of di human right group, don tok say human rights violations by police still dey continue without end,”.