#Sabination, violence against women and girls na very bad thin wey dey come in different forms like domestic violence, sexual harassment, sex trafficking, child marriage, esetera esetera… na dis matter we discuss today, how we fit take help to eliminate dis bad thin for d sake of our sistas, dotas, grand dotas, great grand dotas and so on and so forth #FemiAndMaazi #HowUnaSeeAmPodcast #OrangeTheWorld #GenerationEquality #16Days
Special Guest: Dr. Tomi Ademokun (Host Wellness and Wahala Podcast)
To leave us message, you fit go on top our social media platforms;
Facebook: How Una See Am Podcast
Instagram: @officialhusapodcast
Twitter: @HusaPodcast
YouTube: How Una See Am Podcast
Una fit also call our number +1 (240) 459-8364 and leave comment for voicemail, or use dis link https://wa.me/qr/ZYXR5W3OAUFWL1 add us to WhatsApp and send voice-note. We wan hear from una.
**Music Credits:
UNITY by HUSAPodcast, YellowFela Production
Femi and Mazi, una well done o. Una don bring another matta wey serious well well. Make I put my small mouth inside. Anytime wey i hear person talk ‘solution’ or ‘eliminate’ for this kain matta, e dey make me laugh because anything wey concern human behaviour, e dey hard to stop am kpata-kpata. As our face take different, na so as we take see matta take different. The person wey one person see say get problem, another person dey try enter that position, no single answer dey wey go sweet everybody. My own inside na say if we do our laws wella, say anybody wey physically abuse anybody, man or woman, e get serious penalty wey e go pay like dem fit lock am for prison, maybe people go think am well before dem take hand nack another person. The rest, na d wan wey oyibo dey call social matta wey as una guest talk, na from house as people dey grow dem dey learn that wan. Maybe na training on how to be betta mama and papa we go put mouth inside sef. I see one mama last week wey post video of her 8 year old pikin wey dey dance one kain ashewo dance and people dey comment dey hail the girl, I just taya🤦🏾♂️. What to do?!
Anyways, make una put mouth for violence against men too for another episode, becos we sef dey suffer🤦🏾♂️.
I greet una again. Thank you kakabor🙏🏽🙏🏽