Wetin be colorism?

Dictionary tell us say colourism na the discrimination against pipo bcos of dia skin colour, especially among pipo wey come from the same ethnic or racial group.

Wetin be the difference between colorism, racism, and tribalism.

Racism dey happen between pipo of different race.

Colourism na bias against person just bcos of the color of em skin. E dey happen both within and between different ethnicity, race or tribe.

Tribalism na the strong feeling of loyalty or bond wey person get for him own tribe, and that feeling or bond go come make the person get strong hate or dislike for any person wey no come from him own tribe.

Dis colorism, e dey widespread? And why we no dey hear about am as we dey hear about Racism?

From di small look look wey we look dis matter, we find out say pipo dey talk about dis issue of colorism, but e no be like the way we dey talk about racism. Na as the killing of George Floyd spark serious protest against racism and police brutality for America naim many other nations seize the opportunity to talk about dia own issue of discrimination wey be colorism; Indians especially con come out to talk about colorism for dia country and dia movie industry (Bollywood). China and many other Asian countries con join mouth for di matter. Even multinational companies don dey feel the heat as pipo don dey speak out concerning most of dia products and how dem dey promote and target am.

Wetin be the effect of colorism in our society?

Dis na few of the effect of colorism wey we find…

  • Some researchers find out sey light-skinned women for America dey get approximately 12% less time prison time pass darker-skinned women even if dem commit di same crime.
  • One research wey University of Georgia do for 2006 show sey employers dey prefer light-skinned black men pass dark-skinned men, no matter how di dark one qualify reach. Dat is to sey, black man wey get light-skinned with Bachelor’s degree and normal work experience go dey more preferred to black man with dark-skinned wey get MBA and don hold managerial positions in the past.
  • One law professor for Vanderbilt University study over 2,000 immigrants wey come from different part of the world, he con find out sey di ones wey get di lightest skin dey earn on di average, 8-15% pass similarly qualified immigrants wey dia skin dark.
  • For a place lik America, dark-skinned man wey dem carry go court dey more likely to get conviction and even receive the death penalty pass di lighter-skinned ones.
  • One Company for India wey dey make bleaching cream, wey dem dey call, Fair and Lovely, dey beat dia chest talk sey dem get over 38 million users worldwide. Dat is to sey, na dem carry worldcup for bleaching cream matters.
  • For Brazil, pipo wey get dark skin naim make up 63% of dia poorest sector.

Some resources wey una fit read:

  1. The Colours of Colourism; A Deeply Rooted Global Concern
  2. Colourism: How skin-tone bias affects racial equality at work
  3. Colorism
  4. The people fighting ‘light skin’ bias
  5. What Is Colorism?