For today episode, we talk about April Fool, how and where e start from, den we talk about the traditions wey surround Easter celebration today, all dem Easter egg, Easter bunny.

HOW APRIL FOOL TAKE START?

Historians trace di orijin of April fool’s day, all di way back to around 1582 wen di pipo for france decide to switch dia calendar systen from Julian Calendar to the Gregorian Calendar wey we dey use today. For the Julian Calendar or Hindu Calendar as dem dey call am too, the new year dey start for April 1.

So, pipo wey slow to understand sey Calendar don change go still come out on April 1 wan celebrate new year. Pipo con begin laff dem and call dem “April Fools”. Listen to dis episode to hear more of dis story.

WETIN CONCERN EASTER WITH EGG?

easter eggsBefore Christianity, many cultures, around March and April, dey celebrate the beginning of spring. Spring na the season after winter wey things dey begin grow back again and so most of dis cultures get the tradition wey dem dey use egg take celebrate. Di egg represent Growth, Rebirth and Fertility. According to history, dis customs don dey places like Iran for thousands of years before Christianity. Iranians dat time go boil egg, paint am make e fine well well, use am celebrate dia new year festival wey dem dey call NOWRUZ. Dis festival na around March 20 or 21 dat time.

For Europe dat time too, dem dey use egg celebrate spring as return of the sun god, because na dat period sun dey begin shine again after winter don round up. Infact, many historians don argue sey even the word EASTER, na word wey early European Christians take from di goddess of fertility wey dem dey worship dat period before dem turn to Christians… di goddess name na EOSTRE. Listen to dis episode to get di full gist of easter egg and bunny.