WETIN BE MARIJUANA?

Marijuana na popular plant wey we know with e plenty names like; Cannabis, Weed, Pot, Dope, Chronic, Ganja or the names wey we take grow up back then like; Kpakpa, Moroko, Igbo and many many oda names wey I no fit remember. Di plant dey as old as humanity itself. Ancient cultures like for Asia, around 500BC, discover the some uses for di plant, but no be to smoke am and high, dem be dey use am as medicine only.

Di cultivation of marijuana date back to the early colonist, dem grow the plant specifically for textiles and rope. Di plant contain psychoactive compounds wey dem dey call THC or Tetrahydrocannabinol, dis na di thing wey dey make person high. E also contain other active compounds like cannabidiol or CBD wey no dey psychoactive, dat mean sey dis compound nor dey make person high.

HOW DI PLANT BE?

Di Cannabis Plant

Di Cannabis Plant

Marijuana na part of the Cannabis family wey get thre different children or species wey be; Cannabis indica, Cannabis sativa and Cannabis ruderalis. The type of Cannabis wey no dey make person high or wey dem dey use for non-drug purpose naim dem dey call “Hemp”. Example of wetin dem dey use hemp for na fibre, oil, and di seed too good for food.

Di plant like oda plants get different parts and the different parts get dia own uses, for different industries. the plant get The root, The Stem or Branches, Nodes, The Leaves wey be lik fan, Cola, Stigma and Pistils, Bract and Calyx and den di Trichome. Dis na one plant wey be sey get male and female and na di kin flower wey di plant bring out as e dey grow naim dem take dey know which one be male or female.

WETIN WE FIT USE AM DO?

1. Recreational Use: Na dis one dey come everybody mind once yu mention Marijuana or Igbo as my pipo dey call am. Smoking na di most popular recreational use of dis plant.

2. Food: I know sey e go hard to imagin sey person fit use but yes dem dey use di cannabis plant for food. Animal food like seed for birds and oats for horses and also human food too like the oil and even the seed sef dey good for sleep and digestion. Some pipo dey put am for cake, cookies and some other pastries.

3. Medicinal use: Dem dey use dis plant well well, to make medicine. Infact, na di original use of di plant be dat from time before dem con begin dicover oda usefulness for am. Dem dey us am make antibacteria agents, drugs for Cancer and Aids, drugs for 2 types of epilepsy especially di one for children and dem dey use am for pain killers too, to mention a few.

CBD Products

Some CBD products wey dem dey make for Colorado (one of the states for US wey don legalize Marijuana)

4. Industrial Use: Even tho sey for many pipo, na only di recreational aspect dey come to mind wen dem hear of dis plant, many industries dey use am sotey e dey possible make yu get am full ur house and yu no go know… for instance den dey use am make strong fabric for shoes, bags and even sports wears we I sure sey many of us get for wardrobe.

So many industries dey use dis plant as dia base products e.g. Medicine, Pamarceutical, Wellness & Beauty, Packaging, Banking, Cryptocurrency, Agriculture, Ecommerce, Food, Alchohol, Tobacco, Legal, Textile & Fashion, Plastics, Bio-diesel & Energy, Paper, Construction, Non-Alchoholc Beverages, Sporting and Tourism.

CONCLUSION

We hope sey dis small facts wey we put here don open una mind small about dis wonderful plant especially to open our eyes to all di opportunies wey fit come out from di use of the plant. More resources dey down here if yu wan learn more about dis topic.

RESOURCES

The Marijuana Plant
The positives and negatives: How marijuana affects your brain and body (thejournal.ie)
20 Health benefits of cannabis that everyone should know (healtheuropa.eu)
What are the health risks of using marijuana? | FAQs | Marijuana | CDC
Cannabis in the United Kingdom – Wikipedia
The Surprising Uses Of The Cannabis Plant