WETIN BE DOWRY

Dowry na transfer of gifts, money, properties from the parents to dia daughter as she ready to marry go man house. Many of us, for many years dey confuse Dowry with Bride Price but infact dem be opposite. Bride price na money of material things wey man dey giv family of di woman wey em wan marry.

Dowry na very ancient custom wey many different culture don dey practice since tey tey. Some of di cultures wey don practice dis custom na Babylon, Ancient Greece, Di Roman Empire, China, India, Europe and Amrica. Till date, India most part of India still dey practice dis Dowry system. Listen to dis episode to hear the interview wey we get with one Indian woman wey break the matter down for us.

For most cultures dos days, daugthers no dey fit inherit properties, only sons. So when the daugthers dey go husband house, so that she go fit get small money or property hold on to make she for no suffer for man house, di papa go giv her inheritance in advance and dis one fit range from money to property.

7 FACTS ABOUT DOWRY

  1. Dowry no be Bride Price
  2. Dowry fit help new couple start dia family plus solve some financial problems
  3. Dowry fit come in cash, gold, home goods or properties
  4. Dowry fit make women do inappropriate things to raise money for marriage
  5. Dowry dey make woman tey for market
  6. Dowry dey lead to abuse and sometimes death
  7. Dowry dey lead to Infanticide

RESOURCES

Dowry
Where did the culture of dowry originate?
9 Reasons Why Dowries Are Horrible for Women