Nigeria government on Thursday release statistics of poor pipo for di country. Na di Nigerian Bureau of Statistics release di report.

For the report index wey dem release, dem say na over 130 million Nigerians dey poor. Dis come mean say na about 63 percent of pipo for di African most populated country dey poor.

The tori wey reach us be say pipo wey join hands do dis research, then come release am na di Nigerian Bureau of Statistics NBS, the National Social Safety-Nets Coordinating Office (NASSCO), di United Nations Development Programme (UNDP), di United Nations Children Fund (UNICEF), and di Oxford Poverty and Human Development Initiative (OPHI).

Di report also show say over 50 percent of children for di country dey live wit poverty. Dem base dis their report on 200 million as the population of the pipo for the Country, dem come use over 50,000 families to run di survey across di country. The report also talk say over half of di population wey dey poor dey cook with tins like wood or charcoal, instead of cleaner energy.

Di report also show say 65 per cent of di poor (86 million pipo) dey live for di North, while 35% (nearly 47 million) dey live for di South.

The List of the States with the poorest pipo for Nigeria dey below.

  • Kano – Di state get di highest number of poor pipo for Nigeria. Dem get over 10 million poor pipo. According to senatorial districts, Kano south get 4.3 million pipo wey dey poor, while Kano North get 3.2 million pipo wey dey poor and Kano Central get 2.2 million poor pipo.
  • Kaduna – Di state get di second highest number of poor pipo for di country. Dem get over 8 million poor pipo. Kaduna north senatorial district get di highest number wit over 3 million poor pipo, Kaduna South get over 2.6 million poor pipo while Kaduna central get about 1.5 million.
  • Katsina – Katsina get over 6 million poor pipo wey make dem di third poorest state for Nigeria. According to di index, Katsina Central get over 2.7 million pipo wey dey poor, Katsina North about 2.3 million poor pipo while Katsina South get 1.5 million of dem.
  • Sokoto – Di state na di 4th poorest state for Nigeria according to di report. Dem get about 5.8 million poor pipo.
  • Jigawa – Dis state get about 5.76 million poor pipo to make dem di fifth poorest state for Nigeria. Jigawa North West get about 3.3 million pipo. About 1.3 million poor pipo dey for Jigawa North East about 1.1 million poor pipo dey for Jigawa South West.
  • Bauchi – Bauchi dey for di sixth position of di poorest states for Nigeria. Poor pipo wey for Bauchi central dey over 2.5 million. About 1.3 million of dem dey for Bauchi North, while for Bauchi south.
  • Abia na di state with di lowest number of poor pipo. Di state get only 1.1 million poor pipo.
  • Ondo wit 1.30 million,
  • Ekiti wit 1.31 million pipo
  • Nasarawa get 1.36 million poor pipo.
  • Lagos  wey be di most populated state for di country get about 4 million poor pipo
This tori na according to BBC Pidgin.